Na Small Language Models (SLMs) dey drag Big Tech for AI Matter
Big Big wahala for AI no be say e go take over the world o, but how Big Tech dem go fit use am control people for their own gain. Dem fit dey shape our mindset or behavior anyhow wey go benefit their pocket or political agenda.
Dem big companies like Google go dey use people data anyhow, train their AI models, then go put am behind expensive paywalls. For example, Google spend $60 million every year to dey use Reddit people data, yet dem no dey give anything back to the community wey contribute.
Assisterr: Na Small Player, Big Plan
Assisterr na Cambridge-based project wey wan change the game. Dem dey create infrastructure wey go make decentralized AI easy, and dem dey build small language models wey community go own. With blockchain technology, dem fit track contributions and reward people wey share their data or knowledge.
SLMs dey better pass the big language models for two reasons:
1. Dem dey cheap and easy to maintain.
2. Dem no need too much data size; na steady data updates be the koko.
How Assisterr Dey Work
Dem don already train AI agents wey dey help platforms like Solana and Near Network handle support issues. This one don reduce customer wait time and make documentation better.
By Q2 2024, dem go launch their testnet, deploy AI agents, and later, move to mainnet. Dem future plan na to make SLMs help developers and even build apps for users.
Final Yan
Assisterr no just wan create AI; dem wan make AI belong to everybody, especially the people wey dey contribute data. Dem believe say na community get the power to make AI fair and decentralized.
To sabi more, go CoinTelegraph link or subscribe for their updates.
Translated by Davy Michael